11/02/2024
Afrobeat vs Amapiano derby!!!
Abeg make una help me tell Jose Peseiro make e calm down small because na Mamelodi Sundowns boys we won play no be Argentina.😄
Jose Peseiro don unlEash infact release di lineup wey Super Eagles go use wonjure Southy people today.
• Na the same 3-4-3 wey we use cable, Ivory Coast, Cameroon and Angola na im Jose Peseiro still use but na only one changes e do.
• Ola Aina go play left back today (Sanusi no train yesterday)while Osayi Samuel go play right back.😋
• Like I said earlier, Victor Osimhen go score goal today infact if Victor Osimhen no score today I go run commot for Facebook!!!!!!
This match na 1-0, Nwabali go keep anoda clean-sheets, South Africa go get beta shot on target because their players sabi wire shot but dem no go see goal.
C'mon Eagles!!!!!!!!
📷: Eagles trackers