18/09/2024
Hummmmmm
Dem say Boko Haram don poison beans
after I buy half bag for house. From the one
wey I cook, I give my dog, Bingo, make im
first test am. 45mins later, bingo still dey
waka, dey jolly. Na im I come chop my own.
After I don chop finish, my gateman run
come tel me say bingo don die, hey! I run
enter house, begin drink full gallon of palm
oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3
long bitter leaf stem, chop walnuts with the
shell no time to crack, swallow moringa with
aloe vera as treatment combo. Garlic and
onions be like sweet for my mouth. I come
dey sweat as if na oven be my bedroom. I
dey think say my life don finish. I come
outside. Na im gate man com they tell me
say the driver wey kill bingo wan come beg
me! If na u, wetin u go do the gate man?
Don't laugh alone.........