29/10/2025
Who dey house
Funke: pigdin nurse na me dey house,abeg as i dey so I no dey in the mood,body dey shake me,eye dey turn me,I no get strength to talk o
Pidgin nurse:🤔🤔🤔🤔🤔this symptoms wey you dey tell me be like topic wey I won talk
Funke:Pidgin nurse:wetin you won talk,you don dey turn 🦜🦜🦜
Pidgin nurse: 🤔🤔 hmmm,what a beautiful insult,make I be 🦜
So let gather and learn,today we dey talk about a topic called HYPOGLYCEMIA and wetin e mean
Hypoglycemia (Low Sugar)
Hypoglycemia na when person blood sugar don drop too low. E fit happen to people wey get diabetes or even person wey never chop for long time.
Wetin fit cause am(Causes)
If person use too much insulin or diabetes drug.
If person skip food or no chop well.
Too much exercise without food.
Drink alcohol on empty belle.
Wetin you go notice(Signs and Symptoms)
Shaking or trembling body.
Sweat dey rush.
Head go dey turn or dizziness.
Hunger go catch you strong.
Heart go dey beat fast.
Person fit confuse or faint if e too serious.
Wetin to do(Treatment)
If the person still dey conscious, give am sweet things like sugar, honey, soft drink, or glucose water.
If e no fit swallow, carry am go hospital quick.
How to avoid am(Prevention)
Always chop food on time.
No take diabetes medicine or insulin without eating.
Take only prescribed drugs
Carry small snack or sweet if you get diabetes.
゚viralシalシ
゚viralシfypシ゚viralシalシ
pidgin nurse Sarah gift
I remain your pidgin nurse Sarah gift
Your health is my priority
Go and do a health check upWho dey house

Go and do a health check up