22/03/2026
Canada 2026-2027 immigration plan go reduce international workers and students, set new target for temporary residents
Canada flag wit bridge for di backgroundWia dis foto come from,Artur Widak/NurPhoto via Getty Images
21 March 2026
Read am in 4 mins
Canada through di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) don release dia 2026/2027 plan to reduce foreign workers and international students so dem go fit control dia immigration system.
Di Minister of Immigration, Refugees and Citizenship for Canada, Lena Metlege Diab, tok say di plan go help restore control of di immigration system and also bring am to sustainable level.
According to di document wey Canada immigration ministry make available, dem outline dia priorities and also di annual targets for permanent residents for di next three years.
For February 2026, di IRCC bin unveil new categories under di Express Entry system for international workers wey wan come work for di country.